“Area to the World” is Erigga and Victor AD turning local reality into a global statement. The song carries pride without arrogance, showing how stories from the streets can travel far when they’re told with truth and heart. Area stands for the hood, the everyday environment that shapes character, hunger, and resilience. Erigga delivers grounded verses about coming from the bottom, staying authentic, and speaking for people whose voices rarely reach big stages.
[Intro]
Abeg!
Omo e get weytin i just dey observe ehn for this industry
*It’s Victor AD nahnah ye e*
*It’s paperboi*
Motivate yourself men Area!
The Erigma
[Verse 1 (Erigga)]
E pain me say na wen I go na hin everywhere burst
People wan know if na true dey check Insta blog
Rappers dey throw backie happy wan kill dem die
As Erigga no dey again people go feel dem die
Even rappers wey no dey post my song before
Fake love don put me for their profile picture
They screenshot their dm wen I dey write dem
Say make we run feature see me see problem
Followers don increase go 1.5 m
OAP since morning dey jam me for Fm
My videos wey soundcity no gree accept
Dey on every rotation even my concert
Na so e for be but oluwa forbid
My song go speak for me anyhow e be
Who go better go better na time e go take
Day break everywhere burst for goodness sake
See upcoming rap shows
Get tickets for your favorite artists
You might also like
The Erigma 2
Erigga
Welcome to Warri
Erigga
Hustle
Teni
[Pre Hook : (Victor AD)]
I say tell dem the full story but dem no dey believe o eh
No matter how you watch film d story inside no fit change o
I be dey give dem the full load down but but dem no believe o eh
Who God don bless world people no fit change o
[Hook]
Area o, area o, area o ehh (Warri to d world)
To the world o , to the world o , to the world o eh
Area o area o area oo eeeh (Paper boy Abeg!)
To the world o to d world to d world o eeh
[Verse 2 (Erigga)]
I remember wen I no get bar
That year na wen I dey de edjeba
Madam no meat just put soup with 5 eba
No be enjoyment I come na for survival
No where to go wetin man go do
Na around 2 we dey thief fuel from people motor
Dey sell give who get I pass my neighbour
Rechargeable lamp dey listen to omadebo
As e dey give us gist about celebrities
No internet Na him be out everything
I remember when I track am for DBS
Give am my jam e no play am e pain my chest
Because I know d stress wen I don go through
No sponsors sef na money why u save for school
Na hin I take record am wetin man go do
Give up no join abolie sup wit you
[Pre Hook : (Victor AD)]
I say tell dem the full story but dem no go believe o
No matter how u watch film d story inside no go fit change o
I be dey tell dem the full load down but dem no believe o
Who God don bless world people no fit change o
[Hook]
Area o, area o, area o ehh
To the world o, to the world ehh, to the world
Area o area o area o ehn (Abeg! Wahala)
To the world o to the world oo to d world
Outro
Omo see the character
Na only time e go take stammerer go call him papa name
Motivate your mother*cking self man
Uploaded by: Nnamdi • Upload date: 12/19/2025
More Songs by Erigga
Alcohol
Erigga, Waxiu J...
